Patience na the key

#pidgin_dawah

The life get as e be.. one moment you dey jolly, another moment you dey sober.
As Muslims, we no suppose to get any shakement as we dey experience the two...

 This na because our ogbonge religion wey get levels don sermonize us wetin we need to do at every condition.

Person wey dey happy and joyous suppose to dey show gratitude and person wey dey grief suppose to dey swallow patience.
Allaah don talk am for many many places for Qur'an say He go fitnatize us with different things.

Na Hunger?
Na loss of lives?
Na reduction in wealth?
Na trials in marriage?
Na poverty?
Na lack of children?

The list plenty and e dey endless... If we say make all of us write down our individual problems wey dey give us serious close marking everyday... Facebook post and comment session go be like one room self contain (e no fit accommodate am).

Las Las, Allaah talk am say na those wey swallow patience... Na dem be the guided ones and na dem go enjoy the Mercy wey He get yanfu yanfu and also better news dey wait for them.

For another place, He talk am say "Indeed Allaah dey with the patient ones" suratul anfal

For another place, He talk say "if you endure with patience, e go better for the one wey dey patient" Suratul Nahl

For another place, He talk say "Allaah love person wey dey patient" Suratul Aal 'imran

Our "Chairmo", Prophet Muhammad Salla Llaahu alayhi wa salaam don talk am finish inside one Hadeeth wey enter class say "dey no give any body anything wey better pass and wey dey more generous than patience" Bukhaariy and Muslim.

We fit go on and on but we make we rest for another day...No be how talk take long, na e take dey enter body... Na Allaah barakah for wetin we talk be the Koko.

I use style beg Allaah make He make us from the people wey get patience

Aameen

Aboo Aneefa

Post a Comment

0 Comments